Home As e de hot We no get Measle outbreak! – Kogi state

We no get Measle outbreak! – Kogi state

219
0

Di Commissioner for Health, Dr. Zakari Usman don reveal say Kogi no get any Measle outbreak and news wey some media people dey report about di outbreak for dia state na lie.

He yan say maybe dem start to dey spread di news because of one measles sensitisation programme wey di Primary Health Care Development Agency for di state been do di week before.

Di agency been give cumulative statistics for Measle cases wey di state been don get since January reach September and that for now, no active case dey for Measle.

Di Commissioner still beg make di Kogi state people no follow di news wey dey spread say Measles don get 52 people for di state.

Usman still come promise say di ministry go continue to dey collabo with the media so di public go dey get correct informate about health mata for di state.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.