Di Federal Government on Wednesday don reveal say dem go start construction work for vaccine production plant by the end of 2022 after dem sign contract for manufacturing with Serum Institute of India.
Di Minister of Health, Dr. Osagie Ehanire been reveal dis news after dia Federal Executive Council meeting inside Aso Rock Villa, Abuja.
Ehanire yan say na routine vaccines wey dem call ‘the expanded programme on immunisation,’ dem plan to produce, no be COVID-19 vaccine.
He also tok say everything don ready, from survery to approval and di only thing dem need now na to start to dey break ground to build factory and di company wey both government and private own wey be Biovaccines Nig. Ltd, go open shop for inside Ota, Ogun State to make vaccines wey go prevent IPV, measles and yellow fever, and plenty others and Biovaccines don settle with Serum Institute of India as their partner.
Ehanire come point out say e don dey very crucial for naija to dey produce vaccines because vaccine subsidies wey dem dey get from international community go end in di next six years.