Home As e de hot We go fish out fake and expired pharmacists – PCN

We go fish out fake and expired pharmacists – PCN

273
0

Di Pharmacists Council of Nigeria don seal 342 pharmacy and patent medicine outlets and dey also arrest one person for Ogun.

Di Director of Enforcement, Mr. Stephen Esumobi been yan dis one on Friday for Abeokuta and he say di exercise na part of how di council dey try to clean di way drug dey take distribute for di country.

He also yan say dem been visit 646 premises come seal 342 because say dem dey operate without registration or dem no renew dia certificate or di place where dem dey store things dey bad plus some dey abuse sale of dia drugs, dem no employ superintendent pharmacist and dem dey train dia apprentice unofficially.

Esumobi still come add say dem been arrest one person because him dey collect money from back for registration and renewal of papers, come even generate remitta on top. Dem tok say dem go carry go court on Monday.

Esumobi come beg make naija people dey buy día medicine from pharmacies wey dey registered, come get license because dem go continue dey raid bad medicine stores.

Report dey show say this one wey even happen been happen for different parts of di state like Sango-Ota, Ilaro, Ifo, Sagamu, Mowe/Ibafo, Ogere, and Abeokuta.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.