Di Federal Government don set to deworm 10 million children wey dey primary school for National Home-Grown School Feeding Programme so dem go boost dia health.
Na di Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management, and Social Development wey go direct am.
Di Minister, Hajiya Sadiya Umar-Farouq wey Special Adviser to President Muhammadu Buhari on National Social Investment Programme, Mr. Muhammad Nasiru-Mahmud represent been tok dis one for Kano on Wednesday when dem dey do opening to train people wey go do dis deworming exercise and programme to feed school pikin dem.
Umar-Farouq tok say na dem and Federal Ministry of Health dey join hands to do dis exercise and na Presido Buhari been introduce NSIP wey carry NHGSF so dem go make sure to boost nutrition of pikin dem.
Di person wey dey in charge of di programme for Kano State, Alhaji Baba Aminu-Zubairu, tok say di state been bring di school feeding programme for pikin dem wey dey Primary Four to Primary Six and e don increase children number wey dey register for school.
.
(NAN)