Home As e de hot We don vaccinate 5,000 dogs – Bauchi State Govt.

We don vaccinate 5,000 dogs – Bauchi State Govt.

66
0

Di Bauchi State Government don report say dem give 5,000 dogs injection wey go fight rabies for 20 local governments areas for di state.

Di Director wey dey see for Veterinary Services inside di state Ministry of Agriculture, Dr. Ibrahim Bello, tok for interview with News Agency of Nigeria inside Bauchi on Monday say na dia anti-rabies vaccination campaign do this exercise so dem go fit cut down how di disease dey spread for di state.

Rabies na very deadly virus wey human being dey get from saliva of animal wey get am, when di animal bite person.

Animals wey dey get normally spread dis disease na dogs, bats, coyotes, foxes, skunks and raccoons.

Bello come tok say di ministry go still vaccinate another 5000 dogs for next exercise wey go start for Oct 19, 2022 and make people wey get pets especially dogs bring dem out for di exercise.

Di Oga Director come cry say di number of dogs wey just dey waka about, wey no get owner for di state dey worry am.

He still yan say many dogs never register with di correct office so dem go know who don vaccinate and di one wey never vaccinate and dis no dey help because dem fit dey transmit di disease especially di ones wey never take vaccine.

Bello still come advise people wey get animals make dem make sure say dem dey go veterinary clinic to collect every vaccination for dia pet.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here