Di United Nations Office for Coordination of Humanitarian Affairs inside statement for OCHA for Maiduguri announce on Monday say dem don release 10million dollars under di Central Emergency Response Fund for urgent aid for victims wey dey di Northeast Nigeria food and nutrition crisis.
Di UN agency yan say not less than 1.74 million pikin dem wey dey under 5 dey suffer from acute malnutrition for the northeast area this year.
E come say e dey very bad and na matter of life and death because more than 5000 fit die and di ones wey survive go carry lifelong disabilities.
Mr. Matthias Schmale wey be di UN Resident and Humanitarian Coordinator for Nigeria yan say e dey very important to get money to close that gap so di children dem go dey live normal life, fit go school join.
.
(NAN)