Home As e de hot We don get new Fund Initiative to prevent pandemic – World Bank

We don get new Fund Initiative to prevent pandemic – World Bank

134
0

World Bank don announce say dem don get new Financial Intermediary Fund (FIF) we go solve finance palava to help pandemic prevention, preparedness, and response (PPR) for di national, regional, and global levels.

World Bank reveal say di fund wey FIF Governing Board establish dem self for di meeting wey dem do from 8 to 9 September, go provide way for more money wey go back di PPR capabilities for inside di low-and middle-income countries.

Na World Bank Board of Directors approve di fund for 30 June and dey tok for statement wey dem release on Friday say na dem go still be di trustee for FIF plus dem go host di Secretariat with technical leadership dem go get from World Health Organisation (WHO) as dem go open account for proposals for investments wey dem go need fund by November.

Dem still tok say dem don already get more than US$1.4 billion in financial commitments and even Bill & Melinda Gates Foundation, Rockefeller Foundation, Wellcome Trust, European Commission, Australia, Canada, China and 15 other countries don make commitments too.

World Bank Group President, David Malpass, yan say na coro been show dem say dem need to build health care system wey strong because if dem do investment now, e go save dem money and other resources for future.

.

(Premium Times)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.