Di German government don reveal say dem don contribute more than 200 million euros to support the fight against polio inside Naija for di last 20 years.
Di Kreditanstalt für Wiederaufbau (KfW) Portfolio Manager for the German Government Credit Institute for Reconstruction Mission, Vincent El-Haida, been yan when he visit family health clinic for inside Abuja on Thursday say partnership don dey between Naija and German governments for fight against polio.
Mr El-Haida reveal say di German team dey naija make dem monitor, come still properly assess progress wey don happen already for di fight.
KfW na international organisation wrty dey work with dia partners for developing countries make dem commot polio kpata kpata.