Oga Commissioner for Health for Kano State wey be Dr. Aminu Tsanyawa don confam say dia state government dey plan to add more money for di budget wey dem get to fight Monkeypox and other deadly disease wey dey disturb di state for 2023.
Di Commissioner come yan say from 2014 till now di government for di state don dey increase allocation money wey dem dey give health from 6 percent to 17 percent even tho money no too dey di state.
Tsanyawa point out say dem get wetin dem call State Health Sector Strategic plan for 2023 so dem go fit complete one cancer centre, four Emirate Hospitals, and an ICT centre for di ministry.
Tsanyawa wey say these things for di State’s Annual Operational Planning (AOP) for Health Sector on saturday, still tok say with plan wey dem get, di state fit still add more money so dem go fight any disease or infection wey go come out like Monkeypox.