Di Minister of Health wey be Dr. Osagie Ehanire don beg make traditional rulers dem make sure say Primary Health Care service delivery and vaccination of COVID-19 dey go on well for South-East.
Ehanire tok dis one when dem dey do setup for di South-East Traditional Leaders’ Committee (SETLC) for Primary Health Care (Services) Delivery inside Enugu on Friday.
Na di Federal Ministry for Health been collabo with National Primary Health Care Development Agency (NPHCDA) and Enugu State Primary Health Care Development Agency (ENS-PHCDA) to organise dis event.
Di Minister come yan say if traditional rulers dey mobilised, dem go fit push PHC and also COVID-19 vaccination and because say dem get influence for dia community, dem go help di ministry.
He come still yan say with di event wey dem do, Traditional rulers go know wetin dey happen, come still have good input for di work of PHC.
Gov. Ifeanyi Ugwuanyi wey be governor for Enugu State tok say as dem be gatekeepers for di communities, e dey good say dem dey involved so dem go serve día people well.