Di Lagos State government don tell di public say dem don bring out book wey get guidelines wey people wey dey do traditional medicine go follow for di state.
Di State government reveal say di book na to help manage wetin traditional medicine dey do since 80 percent of naija people dey use traditional medicine to treat theirself.
The Governor of Lagos State, Mr. Babajide Sanwo-Olu wey send him represent wey be di State Commissioner for Health, Prof. Akin Abayomi been tok dis one for di 2022 African Traditional Medicine Day wey dem do inside Lagos on Thursday.
He come explain say di book na to guide traditional medicine people so dem go fit give ogbonge service to naija people.
He still add say di State Government go dey try him best to make sure say dem teach people and make dem see say traditional medicine get benefits and dat di people wey dey do am, dey do am well.