Home As e de hot Tobacco no get license for naija – Group

Tobacco no get license for naija – Group

161
0

Di Nigeria Tobacco Control Alliance don demand say make Federal Government open di tobacco control fund so e go fit reduce effect wey tobacco get for di country.

Reports dey show say Naija na one of di 182 countries for di World Health Organisation Framework Convention inside di Tobacco Control wey don swear say dem go make sure to reduce effect wey tobacco get for di dia country.

Chairmo for di group wey be Oluwafemi Akinbode been tell media people on Thursday say na money be di koko for dem to fit do wetin WHO FCTC tok.

He tok say Federal Ministry of Health don promise say dem go make sure say di Tobacco Control Fund go start work in one month.

Akinbode still yan say dem don tire to dey wait so ministry go start work wey dem promise as e don pass 2 months and dem no dey move.

He tok say na because say di account no dey naim make tobacco work illegal because dem no get license and also e pain am say with bad rep wey tobacco industry get, dem dey do dia business without any rules as license no dey and government no dey do anything.

Akinbode still tok say make di Ministry of Health do wetin e suppose do so di Tobacco Control Fund go dey function well and make di Central Bank of Nigeria, di Federal Ministry of Finance, and even di office of the Accountant General of the Federation put dia head together to make sure say dis account dey work well and money wey government don lose come back plenty as e dey for NTC Act, 2015.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.