Home As e de hot Taraba State don start Tetanus vaccination

Taraba State don start Tetanus vaccination

194
0

Taraba State Primary Health Care Development Agency wey dey collabo with UNICEF, don start campaign wey dem go use stop Maternal and Neonatal Tetanus for inside four local government areas wey dey di state.

Mrs. Mercy Maigoge wey be di State Health Educator been tok dis one for Sunday inside Jalingo and she open up say di meeting na to teach media people about di maternal and neonatal tetanus elimination campaign wey dey happen for four LGAs inside state.

She tok say dem select Bali, Kurmi, Wukari, and Yerro local government areas because say dem get plenty cases and dem need media so people go fit hear and know wetin dey happen and dem go take di vaccines wey dem target for people wey dey 15 to 49 years.

Mrs. Maigoge come still explain say di meeting good so media go know about field monitoring, documentation, and even reporting plus other things.

Maigoge tok say di first stage for di TD wey dem dey also call (TT) vaccination campaign go dey run for 5 days for di LGAs.

She also yan say data wey dem get dey show say di LGAs no dey do well for di tetanus vaccination and na why dem need the campaign.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.