Home As e de hot Share free disposable pads for girls! – NGO to Bauchi Govt

Share free disposable pads for girls! – NGO to Bauchi Govt

140
0

Non-governmental organisation wey be High Level Women Advocates, don beg Bauchi State Government plus other stakeholders make dem dey encourage production and even sharing of disposable pads to schools so dat menstrual poverty go end.

The Secretary for di organisation, Hajiya Halima Dimis yan dis one for di carry-go of di School Pad Bank project wey dem do on Wednesday inside Bauchi.

She yan say e dey very important say young girls get dis free pads especially for schools and she dey happy say di Girl Education Project (GEP-3) wey UN Children’s Emergency Fund dey sponsor don help plenty girls enter school.

Alhaji Babayo Akuyam wey be di Chairmo Bauchi State House Committee on Education for him side yan say di House don pass di Compulsory Basic Education Bill so girls go get free quality education and also di House go bring out budget so girls go dey get free pads too.

Di Commissioner for Local Government and Chieftancy Affairs, AbdulRazaq Nuhu-Zaki come twale for di organisation for di programme dem dey do for di girls and add say dem go also support menstrual hygiene plus child education programmes for di girls inside di state.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.