Queen Elizabeth II wey be di British Monarch wey last longest for di throne don die at 96years for Sept. 8, 2022, just small time after Buckingham Palace tok say her doctors been dey worried for her health.
Dem no give plenty details about how di queen take die, dem just say she die peacefully inside Balmoral Castle for Scotland where she dey spend her late summer holiday but she don been get some health mata recently according to wetin Buckingham Palace been dey release.
QUEEN ELIZABETH BEEN ENTER HOSPITAL FOR OCT. 2021
Late October 2021, di queen been cancel trip wey she been plan to go Northern Ireland and she enter hospital for small time.
Buckingham Palace tok that time say the queen been take medical advise make she rest small.
Later inside that same October, doctors come advise Queen Elizabeth make she no attend one climate summit for Scotland and make she rest for another 2 weeks, make she dey do just small small work.
Dey even advise am say make she no dey take her normal cocktail wey she don drink for years.
BACK SPRAIN FOR NOVEMBER 2021
Just small time after she cancel event for October, Queen Eliza miss one Remembrance Sunday event for London because she get back sprain.
One source been tok say e really pain di queen because di event na wetin she regard very highly but after some days, her son, Charles wey be Prince of Wales tok say him mama dey okay.
THE QUEEN GET COVID-19 FOR FEBRUARY 2022
Queen Elizabeth been get coro for inside late February and Buckingham Palace tok say she been get “mild cold-like symptoms” and she still dey do small small things for inside Windsor Castle.
She been cancel some online virtual meetings wey she get but she later start again early March 2022 tho she come miss Commonwealth Day service for mid-March.
EYE NO TOO SEE QUEEN ELIZA INSIDE SPRING 2022
From late March reach mid-May 2022, the queen no attend any event outside.
She miss Easter Celebration for April, still miss Ceremonial opening for Parliament for May and that na the third time for 70 years when she no attend the opening for di parliament.
Queen Elizabeth come start to dey come out on May 13 as she attend di Royal Windsor Horse Show wey she love.
THE QUEEN NO ATTEND PLATINUM JUBILEE FOR JUNE
Dem been throw Platinum Jubilee to celebrate say the Queen don stay 70 years for throne and plenty events been dey but di Queen no attend.
The queen been go for di Trooping the Color parade, but because of “some discomfort,” as dem tok, she no attend di thanksgiving service for St. Paul’s Cathedral on Friday and she still no go one Derby horse race for Epsom Downs that Saturday.
She still miss di main Platinum Party on Saturday.
For September, last week, di queen been miss di Braemar Highland Games wey she love and dem been do am for Scotland near Balmoral Castle, because of mobility palava.
QUEEN ELIZA BEEN BREAK TRADITION, APPOINT NEW PM FOR SCOTLAND
Normally na for London di Ruler been dey appoint Prime Minister but this time around when Liz Truss replace Boris Johnson inside Sept. 6, dem go Balmoral Castle inside Scotland to do di event.
Na di first time for 70 years wey di queen don rule wey dem dey appoint PM for Scotland and Liz Truss na di 15th PM for inside Queen Eliza rule.
Di next day wey be Sept. 7, the queen come cancel online virtual meeting with her privy council wey be her inner circle of advisors wey Truss dey inside, as doctors been tell am make she rest.
And on Sept. 8, around 1pm EST, Buckingham Palace announce say she die peacefully for her sleep.