Home As e de hot Quack medicine stores don too plenty for Rivers! – PSN

Quack medicine stores don too plenty for Rivers! – PSN

209
0

Di Pharmaceutical Society of Nigeria don dey shout say medicine store and market wey no dey legal don plenty for Rivers State.

Di State Chairman for PSN, Anele Promise been yan dis one when dem do press briefing for Port Harcourt as dem dey mark 2022 World Pharmaceutics Day.

Promise come yan say pharmacists wey dey di state dey work with di officials wey dey di state to make sure say all dis illegal stores and markets go close and he come advise make di state people no dey buy drugs from di quack stores so e no go affect dem.

He come still yan say PSN don dey add more effort make dem fit fight abuse of drug and substance as dem don start program wey go dey educate youths on di dangers wey abuse of drugs dey bring.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.