Dem accuse Medical practitioner wey dem dey call Olaleye say him dey rape him wife niece for dia house for Lagos.
PUNCH Métro dey report say di victim been start to dey live with di family when her papa die and di man, Olaleye come introduce am to pornography, as dem tok.
After that one, di man come tear her leg jump in, and him warn am say if she tell anybody she go enter gbese. Him do dis for about 19months before him wife come find out, go report to di Lagos State Police Command make dem investigate di mata.
Police come arrest Olaleye, transfer am go di Gender Unit of the police command and na dia one investigative police officer, Bimbo Williams carry di case from March 2022, tho petition been go to di Lagos State Domestic and Sexual Violence Response Agency to put eye for di mata.
Di Chairmo for one advocacy group, Radical Agenda Movement inside NBA, Adesina Ogunlana, wey dey try make sure say di victim get justice come dey ask on Monday inside press conference make di state police command and officials of the DSVRT bring di man to book, prosecute am because him don sexually abuse person wey be minor.
Ogunlana tok say police and government agency get enough evidence, even confession wey Olaleye write but still dem never charge am for wetin him do since March 19, 2022.
Other groups wey been come di conference nah Bimbo Odukoya Foundation; Advocate for Children and Vulnerable Persons in Nigerian; Stop the Abuse against Women and Children Foundation; Child Protection Network Lagos State; Piece of My Heart Foundation; and Smile and Shine Foundation.
Report dey show say dem arrest Olaleye on Sunday and dem drop am for di State Criminal Investigation Department, Panti, inside Yaba.
When dem reach di state Police Public Relations Officer, Benjamin Hundeyin, he tok say him no fit confam whether dem arrest Olaleye or not but him know about di allegation and report wey dey against am.