Di Presido for di Nigeria Labour Congress, Ayuba Wabba, don beg Federal Government make dem start to dey pay hazard allowi to health workers for di country sharp sharp.
Wabba been yan dis one for di 2022 annual FCT Nurses Week/Scientific Workshop of the National Association of Nigeria Nurses and Midwives on Thursday inside Abuja and dem title am “Invest in Nursing and respect rights to secure global health.”
Wabba yan say dem don review di allowi but dem never start to dey pay and he still twale give di Minister of the FCT, Malam Mohammed Bello say him do well pay Healthcare workers on time.
Bello for him own side come twale give nurses say dem dey try well well for Healthcare and also di ones wey dey FCT dey really do well especially for Covid19 pandemic time.
He still come add say nurses and other health workers don dey for front dey fight malaria, chicken pox, and other health issues and that FCT go continue to dey support dem and make sure dem dey alright.
.
(NAN)