Home As e de hot Ondo, Bauchi and Edo get 70% of Lassa fever cases – NCDC

Ondo, Bauchi and Edo get 70% of Lassa fever cases – NCDC

267
0

Di Nigeria Centre for Disease Control don reveal say na Ondo, Edo and Bauchi been record 70 percent of di 909 cases of lassa fever wey dem don confam plus di 170 people wey don kpai.

Di person wey dey assist di Director wey still be Head of Response Division for NCDC, Dr. Aderinola Olaolu, been yan dis one for di Ministerial Press Briefing on COVID-19 response and Development in the Health Sector inside Abuja and him tok say response activity still dey go on for every area especially for areas of state advocacy, IPC support, and laboratory diagnostics.

Olaolu yan say di Lassa fever report come from 25 states and 101 LGAs.

He come yan say na effect of covid19 wey dem still dey feel for all dis areas like measles and even yellow fever because say di vaccination campaign wey dem been plan for dem dey delay.

On top of that, he still beg naija people make dem dey careful so dem go dey prevent covid19 and other Infectious disease.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.