Home As e de hot No drink CapriSun for now! See why!

No drink CapriSun for now! See why!

190
0

Di big American company wey dey make CapriSun, Kraft Heinz, don announce say dem dey cancel ‘CapriSun Wild Cherry Flavoured Juice Drink Blend’ wey dey about 5,760 cases, because e be like say e dey contaminated as dem make mistake for factory pour solution wey dem dey use maintain equipment inside one production line for inside one if dia factory.

Dey come yan say dem dey cancel am because some people dey call to complain say di product dey taste somehow and dem dey also work with with plenty distributors and even retailers so dem go stop to dey sell di beverage for now.

Part of di statement wey di company release with dia Grammer dey here:

“Only the Wild Cherry flavoured CapriSun products with the case/package information below are affected. This recall affects Capri Sun Wild Cherry Flavoured Juice Drink Blend beverages made and sold in the United States.

“Consumers should check of their Caprisun drink for a “Best When Used By” date of June 25, 2023 and the consumers who purchased these items should not consume the product and can return it to the store where it was purchased.

“Consumers can contact Kraft Heinz from 9 a.m. to 6 p.m. Eastern Standard Time, Monday through Friday, at 1-800-280-8252 to see if a product is part of the recall and to receive reimbursement”.

Di company still add say dem dey make sure say dia product dey safe and dem maintain high quality.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.