Child health experts don warn make parents no dey use vawulence or harsh words when dem dey punish dia pikin dem.
Di medical experts yan say make parents no dey slap dia pikin as punishment because e fit make dem deaf permanently.
Consultant Paediatric Haematologist and Oncologist for di Lagos University Teaching Hospital, Idi-Araba, Prof. Edamisan Temiye yan say as parents dey treat children harshly, e dey increase aggression for di society because dem fit repeat di treatment to dia pikin dem.
Dey also compare say children wey grow for friendly family dey always dey brighter plus dem dey fit express dem self positively for di society than children wey dey receive shout and beat back to back.
Di experts continue say if parents slap pikin and di eyes turn, e fit cause palava for di pikin plus deafness wey fit follow.
Prof. Temiye also yan say e dey very bad for parents to dey starve dia pikin for food as punishment and also e bad say some parents wey no dey allow dia pikin express de self no dey do good for dem at all.
Even United Nations Children’s Fund reveal say shout and beat no dey work for pikin de a snd e go cause more harm than good for dem.
.
(Punch Healthwise)