Home As e de hot No dey ignore pain for your scrotum! E fit be emergency! –...

No dey ignore pain for your scrotum! E fit be emergency! – Experts

187
0

Health experts don warn naija men wey dey get sudden serious pain for dia scrotum make dem no dey fashy di pain but make dem go hospital sharp sharp for checkup because e fit be sign of testicular torsion and if dem no attend to am, di testicle fit commot kpata kpata.

Di experts add say di torsion dey happen for both testicle and e fit lead to infertility for man and him no go fit get children.

One of the experts wey be consultant urologist, Dr. Gabriel Ogah, come explain say testicular torsion dey happen when di testés twist for way say e come cut off or reduce blood wey dey flow from the spermatic cord to the testicle.

Di urologist tok say dem no know wetin dey cause am but things like family genetics fit bring am come and also na teenage boys e fit affect more.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.