Di Medical and Dental Consultants’ Association for Nigeria don reveal say like 500 consultants for different medical fields wey dey work for government hospitals don jakpa to go work where e go favour dem.
Presido for di association President, Dr. Victor Makanjuola, been yan dis one after di general meeting wey dis association do on Sunday and he tok say na problems wey di government never sort out for di health sector and health care workers him dey blame.
He continue tok say di country go need retain consultants wey dey older, wey don dey reach age to retire so dem go fit train di next set of doctors and medical students.
He come still add say dis one go dey possible if government go increase age wey consultants dey use retire from 60 years to 70 years and also make dem tap into medical entrepreneurship because e fit change brain drain to brain gain.
Di Presido come cry say nothing wey government dey do dey work to solve all dis health palava for health sector.
He still warn say him no go fit give assurance say dia union and government go be bread and butter if dem no do wetin di workers demand inside 2 weeks and make naija people better chook head to help for di mata.