Di Presido for di International Pharmaceutical Federation, Dr. Dominique Jordan don yan say more than 100 countries dey take part for di 80th FIP World Congress of Pharmacy and Pharmaceutical Sciences, wey dey happen for Seville, Spain and e go happen from 18 to 22 September.
Dr. Jordan been yan dis one for statement when e dey tok to di press for FIBES centre inside Seville on Tuesday, say di conference go help raise awareness to show how di 3 main domain for pharmacy wey be education, science and practice dey important and also e go help show di contribution wey pharmacy dey make to universal health coverage.
He still add say pharmacy suppose take dia right position for Healthcare system, for di center to help primary health care and also deliver services to fields wey e dey needed like for mental health and to vaccinate children.
Jordan come point out evidence wey come out recently say depression and anxiety been increase by 25 percent for di first year of covid palava and data wey been come out for July show say vaccination for di world been reduce for 2021 and 25 million infants no collect vaccines wey go save dia lives.
.
( Punch Healthwise)