Nigeria Centre for Disease Control don report say di number of people wey don die for Lassa Fever for Naija don reach 169.
NCDC also yan say cases wey dem dey suspect don increase too.
Report dey show now say Naija get 6471 cases wey dem dey suspect and 899 cases wey dem don confam for 101 local government areas inside 25 states.