New study wey Centers for Disease Control and Prevention do don show say monkeypox virus fit lead to neurological complications like brain inflammation.
Public Health officials been notice encephalomyelitis cases wey been link with Monkeypox for 2 young men wey been dey very healthy and for di 2 cases, CDC been find out say di inflammation symptoms been start 5 to 9 days after dem get Monkeypox.
Encephalomyelitis na inflammation of both brain and spinal cord and plenty things fit cause am like viruses wey dey affect nervous system.