Egypt Don report dia first Monkeypox case for Wednesday.
Di ministry for health for di country tok say di person wey get am na Egyptian man wey dey live one country for Europe but him dey visit normal normal, tho dem no call di Europe country where di man dey stay.
Dey tok say di man dey 42 years old and dem don keep am for inside special isolation hospital and him body don dey stable.
Statement wey dem release still yan say dem notice di case when di ministry dey run normal skin check and now dem don follow all di process wey WHO bring out so dem make sure say di disease no spread as dem don check everybody wey been get contact with di patient.
.
(NAN)







