Doctors wey dey under di National Association of Government General Medical and Dental Practitioners don beg Federal Government make dem dey stand gidigba on time incase of disease outbreaks for future for di country.
Di Presido of di association, Dr Dokun Noel, for di 2022 National Executive Council meeting wey dem tag ‘The role of general practitioners in nation building,’ yan say Naija dey always dull when e enter fight against big disease epidemic and dem need to learn from other ones wey don happen before but make dem dey try prevent am first instead of to cure am.
Noël still add say di impact wey dis diseases dey get for economy dey bad well well.