Di governor for Kogi State, Yahaya Bello don order make him people close one new generation church dem dey call ‘The New Jerusalem Deliverance Ministry’, Okene say dem dey yahoo yahoo for dia members as dem dey sell “bulletproof water”, come still dey run health facility wey no dey approved.
Dem yan say di Pastor for di church, Peter Adeiza, don dey run di office since 2008 and many people don kpai for dia becauseof di illegal and unhygienic medical work dem dey practice.
Di state Security Adviser, Commander Jerry Omodara (retd.) with di state Commissioner for Information and Commissioner for Health, Kingsley Fanwo and Dr. Zekeri Usman, respectively plus other government officials, and the security agents been gather carry out di order of di closing on Monday and na dia dem find out say apart from hospital wey dem dey use to help women born pikin still treat sickness, dem dey still use di church as psychia center where dem dey cure ment people because many people been dey wey carry chain for hands and legs.
Di members of di church come still confam say dem dey receive healing from dia Man Of God.
Di state security adviser come reveal say dem been don arrest di pastor before because of investigation wey di State Investigation Bureau of the Police and the Department of State Services dey do to know wetin dey sup for di church.
Omodara come add say dem get all di evidence to show say wetin di pastor dey do dey against both religious and health/medical values. .