Home As e de hot Knack no dey cause Labour for pregnancy!- Expert

Knack no dey cause Labour for pregnancy!- Expert

246
0

Consultant Obstetrician and Gynaecologist, Dr. Philips Ekpe, don reveal say science no get any evidence to backup di rumour wey people dey carry say knacking for third trimester dey help woman deliver because e dey bring labour.

Dr. Ekpe wey be former Secretary-General of the Nigerian Medical Association yan say many women dey assume say e dey happen because sperm from man get prostaglandin wey be substance like hormone and myths dey say prostaglandin dey ripe cervix come help to start Labour.

Di maternal health expert yan say women fit knack for fun but make dem no do am because say dem wan enter labour because for vaginal delivery, contractions gats happen, di pelvic go dey enough and di baby go need lie down well and na nature dey run those ones no be human being.

Di gynaecologist still come beg women make dem dey register for antenatal on time for better hospital wey get birth specialists wey sabi work.

.

(Punch Healthwise)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.