Di government for Kano State don yan say e dey plan to create board for traditional and alternative medicines.
Di state government been reveal dis one for statement wey di Press Secretary release to di deputy governor, Hassan Fagge, on Wednesday inside Kano.
Di statement yan say di governor tok dis one on Tuesday when he dey receive delegation wey Director Department of Traditional Complementary and Alternative Medicine(TCAM), Hajiya Zainab Ujudud -Sharif carry come from Federal Ministry of Health.
Ganduje come yan say di state government go open TCAM department for dia state Ministry of Health to show say dem dey ready to make traditional medicine standard.
He also reveal say as di administration keep health of dia people for heart, dem go make sure say dem commot all di quack wey dey for traditional medicine and dem go also make sure say better partnership dey to make traditional medicine better for di people.
Ujudud -Sharif been tok say dia visit na to ginger di Kano State government to create law so dem go get board and department for TCAM for ministry of health and she dey happy say di state government dey willing and ready to provide better Healthcare for him people.
.
(NAN)