Tuberculosis, Leprosy and Buruli Ulcer Programme for Kaduna State on Friday don reveal say dem don record 4,474 new cases for TB for di state.
Di Deputy Programme Manager for di state, Dr. Sani Aminu, yan this one for di one-day meeting wey dem get with di civil society and private sector people for Tuberculosis Domestic Resource Mobilisation inside Kaduna.
News Agency of Nigeria come report say na di State Ministry of Health collabo with Development Governance International Consult to organise this event.
Aminu tok say from January reach now, dem don record 8,980 cases of TB wey dem don confam and that na 80 per cent increase when dem compare am to 114 per cent increase wey dem get for di Q1 of 2021.
Aminu tok say tuberculosis dey increase and because of dis dem no sure say dem go fit get zero case or zero death by 2030, make dem push am forward.
Him tok say dis programme get plenty challenge wahala wey be how dem go dey help theirself as support wey dem dey get from the national agencies dey reduce, plus wahala of di gap wey dey for case finding, paediatric case finding, and sub-optimal health facility coverage with tuberculosis services.
Aminu come beg government make dem take more responsibility to implement di things wey go control tuberculosis.
He come still add say di programme don get 976 free treatment centres for di state and dem still dey plan to make dem do active community search still increase services wey dem dey do and even do better patient screening and test so e go easy for dem to find more cases to treat on time.
Aminu still add say dem go make sure say dem carry private sector along and also increase pediatric diagnosis as dem go start to dey engage nutrition clinics, chest X-rays, and stool testing for tuberculosis.
.
(NAN)