Home As e de hot Increase retirement age! – NMA

Increase retirement age! – NMA

212
0

Di Nigerian Medical Association don dey request make dem increase age for doctors to retire because e fit reduce brain drain for di health sector.

Di Presido of NMA, Dr. Uche Ojinmah, tok dis one when dem do di 2022 National Conference for di group inside Gombe and dem name am ‘Healthcare Delivery in the Face of Insecurity’.

Di Presido tok say no be only to increase di retirement age but make dem also make sure say security dey gbam and working conditions dey also favour doctors because naim fit be di ogbonge solution.

Ojinmah still tok say more than 1,525 people don get help from dia medical waka because dia association understand di wahala wey dey with health centers wey no get better equipment to work.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.