Home As e de hot Immigration officers don receive mental health training

Immigration officers don receive mental health training

247
0

Di Instinct Resource Services Limited Don train 200 officers wey dey di Nigerian Immigration Service for di country make dem sabi things about mental health.

Di oga Managing Director for IRS, Mr. Ayuba Fagbemi, yan for statement for end of training wey dem do for Port Harcourt, Rivers State, say di event sef na part of effort wey di NIS Comptroller-General, Mr. Idris Jere, dey make to help officers dey more productive for work wey dem dey do.

Fagbemi yan for di statement say dem tag di training ‘Building Mental Health Awareness, Emotional Intelligence and Effect of Psychoactive Substance for Superlative Productivity’, because people no dey look mental health side at all for di country even tho say e dey very importamkpa for di people.

Fagbemi come reveal from statistics wey him get from di World Health Organisation say for di whole world 460million people dey suffer mental health problem and 25 per cent for di population go get mental kolo sometime for dia life.

He also yan say research don show say emotional intelligence na almost 90 percent of wetin set people wey dey do very well apart from others, and come still warn make people avoid psychoactive drugs.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.