Home As e de hot Healthcare must better for we state! – Yobe Govt

Healthcare must better for we state! – Yobe Govt

318
0

Yobe state government don yan say dem don set up 4 specialist plus 8 general hospital so Healthcare go better for inside di state.

Di Commissioner for Health and Human Services, Dr. Lawan Gana been yan dis one on Tuesday inside Damaturu and he reveal say dem upgrade 4 general hospital to specialist hospital inside Buni Yadi, Postiskum, Gashua, and Geidam while Machina, Yusufari, and then dem upgrade Healthcare centres wey dey Jaji Maji to general hospitals. Other ones na Babbangida, Bara, Buni-Gari, Yunusari and Asibitin Malam Baba, Nguru.

Gana come point out say dem been set up Special Baby Care unit for di Specialist Hospital wey dey Gashua and then dem set up 20-bed capacity isolation centres for Potiskum, Gashua, and Yunusari Specialist Hospitals.

Di Commissioner still add say di state government upgrade di Emergency Paediatric Unit and Trauma Centre at Specialist Hospital, Damaturu and still buy new modern equipment for general hospitals inside Damagum, Buni Yadi, Gashua, and Potiskum, and plenty others.

He come still twale give Governor Mai Mala Buni say him dey dedicated to move Healthcare centre to di next level for di state.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.