Home As e de hot Hand sanitizer wey get alcohol no dey dangerous – Pharmacist

Hand sanitizer wey get alcohol no dey dangerous – Pharmacist

275
0

Pharmaceutical Consultant wey be Olatunji Koolchap don clear people say if dem dey always use sanitizer wey alcohol dey inside, e no fit damage skin.

Koolchap tok say science no get any proof say alcohol wey dey inside hand sanitizer fit cause problem for skin and even tho people been carry di rumour say e dey happen, na lie.

Koolchap still add say na alcohol be di koko thing wey dey inside hand sanitizer and na 70 percent concentration e get, other things we dem dey add na just make di sanitizer smell nice.

Di pharmacist still add say if hand sanitizer dey damage skin or remove di skin, di National Agency for Food Drug and Administration and Control and even Food and Drug Administration wey dey United States of America no go register am or dem for don flag am since.

Centres for Disease Control and Prevention come report studies wey dem find say hand sanitizer wey get concentration for alcohol between 60–95 percent dey more active and strong to kill yama yama germs than di ones wey no get alcohol at all or we get small.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.