Nigerian Association of Resident Doctors been give Federal and state governments 2 week notice to do all di things we dem gree for contract and na today, Monday 5th September e dey end but di association don move dia National Executive Council meeting to Saturday, September 10, 2022, inside Jos, Plateau State, so dem go join head together tok about di notice.
Wetin NARD dey demand for na for government to pay di Medical Residency Training Fund wey dem just review, also make government confam and pay sharp sharp di hazard allowi wey dem never pay plus other things.
Di association been first give di 2 week notice for July 30, 2022, make government gree pay or dem go go strike.
Dey still come move di notice on August 21, 2022 so Ministry of Health and the Ministry of Labour and Employment fit helep chook mouth for di matter but still, government never pay anyone.
Di Presido for di association wey be Dr Dare Ishaya come yan say na Ministry of Finance dem dey wait for make dem release money because Ministry of Health don submit all di documents and paper dem need.
He also tok say di wahala wey dem get with Ministry of Health na make dem get team wey go dey check salary for all health workers so dem go dey receive better payment.