Consultant Paediatric Haematologist and Oncologist for di Lagos University Teaching Hospital, Idi-Araba, Prof. Edamisan Temiye, don give some reasons wey make children dey get low Intelligence Quotient and no dey do well for dia school.
Prof. Temiye yan say even tho na genes dey determine low IQ for children, di environment dey affect di children too and malnutrition too dey play big role for low IQ.
Di paediatrician yan say na for womb brain of pikin dey start to develop so if anything happen to break that development, e don affect di intelligence of di pikin be that. If di pikin no get nutritious food to grow di brain, not just physical growth and dey pass 2 years, di intelligence no fit grow again.
Di professor add say make parents dey allow dia pikin dem to explore dia environment so dem go fit develop dia IQ.
.
(Punch Healthwise)