Home As e de hot Ebola don kpai person for Uganda

Ebola don kpai person for Uganda

170
0

Health ministry for Uganda on Tuesday don announce say di country don get one person wey don kpai because of Ebola virus since 2019 when dem been announce di outbreak for di central district of Mubende.

Di World Health Organisation been release statement on Tuesday say one 24-year-old man for Mubende been test positive for di variant of di virus wey be “the relatively rare Sudan strain” and di National Rapid Response team been investigate like 6 deaths wey been happen for that district di same month while 8 other people wey dem dey suspect been dey collect treatment.

Di Sudan strain been don get like 7 outbreaks four times inside Uganda and three times inside Sudan.

Uganda dey share very open border with di Democratic Republic of Congo (DRC) and dem don been get plenty Ebola outbreaks before and di newest one na for 2019 when like 5 people been die.

Di DRC been record new case last month for dia east side less than 6 weeks after dem announce say epidemic wey happen for di northwest don end.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.