Experts wey dey for Child health don beg mama dem make dem dey give dia pikin breast inside 30 minutes to 1 hour after dem don born dem because e get plenty benefits for di pikin dem.
Dem also tok say if mama dem no do this, di pikin fit get serious health palava.
Consultant Paediatric Haematologist and Oncologist wey dey di Lagos University Teaching Hospital, Idi-Araban, Prof. Edamisan Temiye, na one of di experts and him tok say no be only pikin dey benefit from dat early breastfeeding but even mama dem too dey benefit.
Prof. Temiye come warn say if baby no take dat breast milk when dem born dem, di baby fit get hypoglycaemia wey be very terrible low blood sugar for dia blood and e fit cause damages wey doctors no go fit treat for pikin brain.
He still add say to breast feed pikin early go help am to start to dey suck well.
Prof. Temiye still point out say e good for di mama too because e go help her uterus to come back together and reduce blood wey di mama dey lose.
.
(Punch Healthwise)