Home As e de hot DJ Jimmy Jatt survive kidney palava

DJ Jimmy Jatt survive kidney palava

324
0

Popular DJ Jimmy Jatt wey him real name na Oluwaforijimi Amu don reveal say him been get kidney problem recently but e don treat am.

Him post video for social media to tell di story of how him get treatment and transplant for di Zenith Medical and Kidney Centre, Abuja and everybody been shock because nobody know say di kidney wahala been hol am.

Remember say Eedris Abdulkareem been also open up about him own kidney palava recently and e come make Jimmy Jatt wey dey stay for di United States, di second celebrity to reveal him kidney health mata.

Jatt for di documentary wey him make for di hospital come yan say him wan be di face for survival of kidney disease for naija, say him no wan be victim and as him don go through am, he wan dey very open dey tok about him journey and how e be so people go know.

Di DJ still add say him dey very impressed with di kain treatment wey him receive for di Medical centre because him submit him life to dia hands and dem take care of am well.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.