Consultant Urologist for di Lagos State University Teaching Hospital, Ikeja wey be Dr. Oluwaseun Akinola don beg naija men make dem dey do test for prostate all di time so experts go fit find out prostrate cancer on time if e dey because if dem find am early, chance dey say dem go fit cure am kpata kpata.
Akinola been yan dis one on Friday for di Marcelle Ruth Friends Cancer Support Group Educational and free Prostate Cancer Awareness and Screening programme wey Marcelle Ruth Cancer Centre & Specialist Hospital, Lagos organise.
Di Urologist come explain say prostate na organ wey di size dey like almọnd just below di bladder where di body dry keep urine.
Di expert come warn say prostrate cancer no dey carry any sign until di condition don reach advance level and na why men suppose dey go for di screening regularly.
He point out say di cancer dey more common for African men and e dey more aggressive inside Naija than for abroad but di wahala be say dem no dey detect am on time to cure am. For di abroad, dem don detect di cancer for 96 percent of people wey no get any symptoms at all.
Di urologist still add say research don dey go on and e still dey go on to find out wetin dey really cause di cancer but dem never find anything. Di only thing dem know na DNA damage wey dey lead to di problem.
Akinola still add say African men wey don get people for dia family suffer am suppose rush go do test sharp sharp.