Home As e de hot Delta State Govt don dey pay hazard allowi

Delta State Govt don dey pay hazard allowi

282
0

Delta State Government don start to pay hazard allowi for health workers wey dey di state and na dem be di first state for di country wey don start.

Dem been tok dis one for announcement wey Nigerian Medical Association Presido Dr. Uche Ojinmah, and di Secretary- General, Dr. Jide Onyekwelu sign for di end of the August 2022 National Executive Council meeting wey di association get for Gombe State.

Di Federal Government been increase hazard allowi for health workers for di country for December 2021 and dem write am for document wey di Chairmo for di National Salaries, Income and Wages Commission share with reference SWC/S/04/S.218/11/406, and date na December 22, 2021.

Di part wey concern us for di circular tok for plenty Grammer say: “Concerning the review of the hazard allowance applicable to health workers in the services of the federal hospitals, medical centres, and clinics in ministries, departments and agencies.

“The hazard allowance was reviewed to a flat rate that ranges from N5,000 to between N15,000 and N34,000 for health workers on the CONHESS salary structure, while doctors on CONMESS had theirs reviewed from N5,000 to between N32,000 and N40,000.”

Di NMA after dem thank government for the allowi still add say e dey pain dem say dem dey pay di money slow slow like say dem dey force dem and e no good say dem wan commot doctors wey dey MDAs and basic medical faculties for universities from di money, say dem no go gree.

Di association still come yan di Abia State branch make dem stand gidigba for ground make sure say dem fight for all the rights and allowi plus benefits wey doctors suppose get for di state especially di ones wey dey work with government.

Report wey dey be say Abia State Government dey owe NMA members not less than 24-month salaries and allowi.

.

(Punch)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.