Home As e de hot Coro don strike Adamawa with 103 new cases

Coro don strike Adamawa with 103 new cases

231
0

Coro still dey spread for we country everyday as Naija don record 285 new infections inside 6th and 7th September, 2022.

Nigeria Centre for Disease Control (NCDC)been report on Thursday for dia Facebook page say Adamawa State record 103 new cases.

Lagos State wey be like say na dem get infections pass na second with 90 infections and Rivers State come get 46 infections.

Delta State get 33 cases, Kano get 8 and Gombe get 3 cases.

Ekiti and Plateau States get only 1 case each. NCDC still add say Bauchi, Kaduna, Ogun, Ondo, Osun, & Sokoto no get any case at all.

Report wey NCDC drop for coro show say some states never dey do wetin dem suppose do to help cancel di coro spread for di country and now infection don grow to 264,299 and 3,154 don kpai.

Di Centre still tok for dia website say 3,356 people dey very sick and dem don treat come discharge 257,629 people for di country.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.