Home As e de hot Cholera don jam Adamawa people

Cholera don jam Adamawa people

304
0

Adamawa State Ministry for health don confam say dem get 11 cases for cholera inside Guyuk and Shelleng local government areas for di state.

Dr Celine Laori wey be Director for Public Health inside the ministry for Yola tok say for Tuesday dem been get cases wey dem suspect say na cholera wey dey 96 and 11 cases wey dem don confam.

He tok say di ministry been get report of di cases for August 19 and di people been dey get acute watery diarrhea for inside di LGAs.

Laori yan say dem don get chop chop things for medicine, come drop them for di Cholera Treatment Centre wey dem get so e go fit helep manage di disease for di state.

He come come say make all dia partners helep government to support dem so dis palava no go worse.

He still come advise people make dem dey maintain good hygiene and dey careful for di food and water wey dey enter dia mouth so dem go dey safe.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.