Home As e de hot Cholera don dey show Gombe people shege

Cholera don dey show Gombe people shege

157
0

Gombe State don announce cholera outbreak as more than 10 people don kpai from am for di state.

Commissioner for Health for Gombe, Habu Dahiru wey send him represent Executive Secretary of the Gombe State Primary Health Care Development Agency, Abdulrahman Shuaib, yan say as of 20th September cases don increase to 236.

Di Commissioner reveal say di ministry of health don activate incident management system make dem use control cholera for di Primary Health Emergency Centre inside di state and dem don also set up 13 cholera treatment unit for di 5 local government wey di disease affect so dem go fit manage di disease free of charge.

He still yan say dem go start decontamination of wells and boreholes inside di communities wey dey affected plus sensitisation and sharing of treatment water tablets for di communities.

Mr Dahiru still advise people for di state make dem make sure say na clean water dem dey drink plus make sure say na good food wey dem use clean hands and water cook dem dey chop.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.