New study wey researchers for Spain do, don show say if children no dey chop breakfast, e fit cause dem to get psychosocial health palava because breakfast dey help mental health of teenagers.
Di researchers come add say di type of food and where di teenagers chop am also dey very important because morning food wey dem chop for house dey provide physical plus psychosocial benefits for di teenagers.
Di researchers been use data from 2017 Spanish National Health Survey wey include questions wey di parents and guardians answer about breakfast status, place, habits, and children’s psychosocial health and dem carry record of 3,772 Spanish children and adolescents wey dey between ages 4 and 14.
Di result wey dem publish for journal Frontiers in Nutrition come show say 98.9 per cent of the sample chop breakfast and 95.8 per cent chop am for house and e still show say di ones wey skip morning food or no chop am for dia house get higher chances of psychosocial behavioural problems.
Di researchers also report say some kain food and beverage dey lead to psychosocial behavioural problems because di ones wey no dey chop coffee, milk, tea, chocolate, cocoa, yogurt, bread, toast, cereals, pastries, etc for breakfast been get high chance of psychosocial behavioural problems while di ones wey no dey chop eggs, cheese, ham, etc., been get low chance of psychosocial behavioural problems.