United States Food and Drug Administration don warn people say report dey say some cancer dey inside scar tissue wey dey form around breast implants.
US FDA come yan say di rare cancer wey dem don find for di tissue na squamous cell carcinoma and various lymphoma inside di capsule even tho say e no dey too happen.
Di FDA come warn say make people wey dey see to Healthcare and even any woman wey wan add something inside dia breast, as in breast implants, dey careful because dis new one wey dem just report dey different from di other lymphomas wey dem been don report say breat implants fit cause.