Home As e de hot Blue cut lenses fit damage your eye! – Experts

Blue cut lenses fit damage your eye! – Experts

347
0

People wey be specialists for Eye care don warn naija people make dem no dey use di blue-cut glasses wey dem buy for market, di one wey doctor no give dem because e fit cause serious palava for eye.

Di experts reveal say people suppose dey use di glasses after dem don run test to find out wetin dia eye need, so di doctor go give dem di right glasses.

Dem still yan say some blue-cut glasses fit block blue light wey good for eye and dis one fit spoil something for di eye cycle and e go come lead to seasonal affective disorder wey be type of seasonal disorder.

Di optometrists wey be Drs. Chinedu Njezi and Lynda Agu reveal say person wey dey always look electronic screen fit carry serious and plenty eye problem.

Njezi reveal everybody wey dey use electronic devices like phone and computer suppose get di right blue cut blocking lenses from doctor wey sabi.

Agu for her own side tok say if person use di right blue cut glasses, e fit save him eyes from dangerous blue rays wey dey come from laptops, phones, sun, and some other gadgets.

She still add say na only test person fit run to know di glasses wey dey necessary for person wey no wan get problem from these dangerous blue rays and na for clinic di person go get am after optometrist don check him eye well.

Di experts still come warn say eye glasses na medical devices and if person no use am well e fit do di person bad instead of good.

.

(Punch Healthwise)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.