Home As e de hot Bleaching creams fit kpai you! Stop am! – NAFDAC

Bleaching creams fit kpai you! Stop am! – NAFDAC

239
0

Di National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) don warn make naija people no dey use too much bleaching cosmetics because e fit lead to skin cancer.

Dem been yan dis one for statement wey di Consultant for di agency media, Olusayo Akinola sign wey dem drop for Abuja on Sunday.

Di statement reveal say di madam Director-General for di agency, Prof Mojisola Adeyeye, been yan for di brainstorming session wey dey get for weekend for Lagos say di abuse wey dem dey abuse cosmetic fit even cause internal damage to organs wey dey di body and e fit kpai person too.

She say e shock am say people wey dey call día self beautician just dey mix mix chemicals wey no dey authorised and dem dey apply am for di skin of clients wey no sabi wetin dey sup.

Adeyeye still yan say many spa for di country dey do this unhealthy mixture of chemical and natural things like pawpaw, carrot and others so dem go make cream for dia clients and later dem go come package am, label am dey sell online to peoe wey wan white by force. Even now sef, spa people don drag some doctors join to do dis bad behaviour.

Di NAFDAC boss still yan say dem don even advance to dey do vitamin C infusion and glutathione wey dem dey inject into di mixture to put on client body.

Adeyeye come reveal say di problem for dem be say di Spa people dey always do dis concoction for clients personally and you no fit find di yama yama mixture for dia shelf but if dem catch anyone, dem go prosecute come jail dem on top because most of di chemicals dem dey use for mixture dey smuggled to di country and e no dey registered like things wey carry Kojic Acid, and Hydroquinone to level wey pass wetin dem suppose dey.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.